Romantic Nigeria Pidgin Love Poems in English Language for the One You Love - Lovingly – Expressing Love, Endlessly and Lovingly! Romantic Nigeria Pidgin Love Poems in English Language for the One You Love
Advertisement

Romantic Nigeria Pidgin Love Poems in English Language for the One You Love

Best Romantic Nigeria Pidgin Love Poems in English Language for the One You Love

Romantic Nigeria Pidgin Love Poems In English Language For The One You Love. This one na we Nigerian romantic love poems for your one and only true love. This Naija love poems na wetin go totori the heart of your sweet love. This short poetic pidgin poems  are Your Love Dey Make Me Smile and If No Be You. We know say your special somebody go enjoy am weller. 

I am still in that Nigerian romantic mood. Seriously this romantic totori love poems for your one and only na the thing wey go make her heart dey sweet for you.

What more than to give you some taste of real naija romantic poems in the language that will make your love interest go ever gaga for you. Best Naija Pidgin Love And Romantic Poems For Your Special True Love

This love na wetin go make your person head scatter with sweet feelings of thinking about you all the time.

If you understood how it feels like to be in love; doing some crazy positive things for the sake of it then you would know that loving someone and that person loving you back goes a long way to make things much more easier. Enjoy these totori love poems!

Your Love Dey Make Me Smile

When I got to sleep at night
All I long for na to hold you
Inside my arms till the morning
I want to be around you
Every moment and all the time
Na the thing wey dey give me joy.

In the morning
All I want to see
Na you my sunshine
You dey totori my heart
And make me feel anew
This your love na better thing
Wey do happen to me.

A thousand mile
Be like one day
Every time I see you
If no be you
I for never know say
Love sweet pass sugarcane.

You be my ever true love
The one wey dey make me smile
My correct better person
Wey dey give me joy back-to-back
If no be you na no one else.

Na you dey make me smile
Still na you dey make me cry
With love that makes me laugh
This our love na Five and Six
Nothing go separate us till forever.

Nsikak Andrew

Will you be bold enough to declare your love for that special person? If you dey shy, abeg make e stop. Go all out and express yourself without reservation if you have found that special somebody. Happy Romantic Wedding Anniversary Love Poems To My Wife

If No Be You

If no be you
Then there is no other
Na you be
The correct person for me
Every time you call
I go dey run back to you
For you I go fit do anything
Just to see you smile.

Make them talk
Me I no send
I wish them know
This love wey I feel for you
Them for no dey talk anyhow
You be my personal person
The one wey dey make me happy.

If no be you
Water for don pass Garri
You steady me
When nobody believe
You open my eyes
When I still dey doubt
If true love exist.

Today
You don turn my doubt
And make me see
The meaning of true love
My Hero, my Champion
You are my better love
Wey I no fit let go
For if no be you
I for think say love na lie.

Nsikak Andrew

Post a Comment

Post a Comment (0)

Previous Post Next Post
Advertisement
Advertisement