Sweet Nigerian Pidgin Love Poems in Pidgin English - Lovingly – Expressing Love, Endlessly and Lovingly! Sweet Nigerian Pidgin Love Poems in Pidgin English
Advertisement

Sweet Nigerian Pidgin Love Poems in Pidgin English

Best Sweet Nigerian Pidgin Love Poems in Pidgin English

We no need to tslk am twice, soup wey sweet, na money kill am. And I say love wey sweet, na you kill dey work dey wonder. This collections of some of the best sweet Nigerian pidgin lover poems in pidgin english na love poems wey you fit send to the one wey dey give you love. This poem na wetin go scatter brain wella.

Naija Pidgin Love Poems

Your personal person na the one wey dey give you joy. Na the person wey him love dey totori your head. We thought of you with some Naija flavored pidgin language and want you to take a funny romantic step to send this romantic totori love poem to your correct person. These romantic poems na better matter wey go make your person begin show you love like you never see am before.  

The Thing Wey I Dey Hide From You

Something wey I dey hide inside my heart
Na the matter I want talk about today
This feeling of you nothing go fit stop am
I don try make him stop to worry my mind
But the more I dey try, na so I still dey see am.

This na love I know say I dey feel for you
For you I no go search for another again
Na you be the correct person wey I like
Better love wey go make me stop to search
And forever I want to live for you.

You make me fall in love like never before
If I sleep na you I want see for my dream
And if I wake up still na you I want to see
You steady me with all the things you do
This love wey you dey give me na final.

Today make I tell you one thing wey be true
This thing wey I don dey hide from you since
Na you be the Angle wey dey comfort my heart
And since wey I start to fall in love with you
The different don clear pass Seven-Up.

Nsikak Andrew

Love Poem in Nigerian Pidgin

There is nothing wey fit make you feel better like the love of that special person you care about. When you feel loved, you have it at a go to do all it takes to make that love feel so special. If you have gotten that special person in your life, make you no play with am o. Abeg, send this romantic totori poem make your person feel happy like tomorrow no dey.

Na Your Love I Dey Feel

Na your love
I dey feel inside my heart
And the matter
No let me sleep for night
If you search my heart
Na your love dey reign
And if you think say na lie
Abeg look inside my eyes
Na there you go see
Say na true talk I dey talk.

I don search many places
But I never see the love
Wey be like your own
You correct no be lie I talk
Na your love dey give me joy
Everytime I think of you.

Na you be the person for me
And your love be the thing
Wey dey make me happy
You be better treasure
Wey I want keep forever.

Every morning you be
The first person wey I want see
Every afternoon you be
The Sun wey I want
Make him shine on me
Every evening, I want your love
Make him cool my heart
Everyday na you I want
Make him be my true love.

Nsikak Andrew

Romantic Naija Love Poem

I am still in that Nigerian romantic mood. What more than to give you some taste of real Naija romantic poem in the language that will make your love interest go ever gaga for you. This love na wetin go make your person head scatter with sweet feelings of thinking about you all the time. If you understood how it feels like to be in love; doing some crazy positive things for the sake of it then you would know that loving someone and that person loving you back goes a long way to make things much more easier. Enjoy these Naija love poems!

Your Love Dey Make Me Smile

When I got to sleep at night
All I long for na to hold you
Inside my arms till the morning
I want to be around you
Every moment and all the time
Na the thing wey dey give me joy.

In the morning
All I want to see
Na you my sunshine
You dey totori my heart
And make me feel anew
This your love na better thing
Wey do happen to me.

A thousand mile
Be like one day
Every time I see you
If no be you
I for never know say
Love sweet pass sugarcane.

You be my ever true love
The one wey dey make me smile
My correct better person
Wey dey give me joy back-to-back
If no be you na no one else.

Na you dey make me smile
Still na you dey make me cry
With love that makes me laugh
This our love na Five and Six
Nothing go separate us till forever. 

Nsikak Andrew

Romantic Love Poem in Nigeria Pidgin Language

Will you be bold enough to declare your love for that special person? If you dey shy, abeg make e stop. If you are still alive, there is nothing wey go make you escape love. Love na one wonderful thing that makes life go round. If you are in love, this touching naija romantic poem is for the special person in your life. Go all out and express yourself without reservation if you have found that special somebody. 

If No Be You

If no be you
Then there is no other
Na you be
The correct person for me
Every time you call
I go dey run back to you
For you I go fit do anything
Just to see you smile.

Make them talk
Me I no send
I wish them know
This love wey I feel for you
Them for no dey talk anyhow
You be my personal person
The one wey dey make me happy.

If no be you
Water for don pass Garri
You steady me
When nobody believe
You open my eyes
When I still dey doubt
If true love exist.

Today
You don turn my doubt
And make me see
The meaning of true love
My Hero, my Champion
You are my better love
Wey I no fit let go
For if no be you
I for think say love na lie.

Nsikak Andrew

Naija Pidgin Poems for the One You Love

Na the one you love supposed to be your everyday happy love tonic. The person suppose to give you joy. If you have gotten that souldmate, come share these Nigerian pidgin love messages and romantic love poems with that sweet soul of yours. The happy love tonic and I want to be there for you is something wey go make the heart jolly like nothing dey happen.   

My Happy Love Tonic

Two heart wey dey beat as one
That the thing wey dey make
My heart happy like no tomorrow.

You dey give me too much love
Wey come dey make me jealous
Like say na dream I dey dream.

My happy love tonic
Na you be my ego
The better thing we be my own.

I love you that no be lie
I got do anything for you
That the simple truth.

If love be person
Na you be that person
My better love tonic.

I go always dey here for you
As you don make me fall in love
You be the one wey no get equal.

Nsikak Andrew

Post a Comment

Post a Comment (0)

Previous Post Next Post
Advertisement
Advertisement