Pidgin Love and Inspirational Poems in Nigerian Pidgin Language - Lovingly – Expressing Love, Endlessly and Lovingly! Pidgin Love and Inspirational Poems in Nigerian Pidgin Language
Advertisement

Pidgin Love and Inspirational Poems in Nigerian Pidgin Language

Best Pidgin Love and Inspirational Poems in Nigerian Pidgin Language

This love and inspirational pidgin poems in Nigerian pidgin language na wetin be the main thing now wey go make you laugh and also make you feel good. Nothing do you if you send these poems to your personal person. Enjoy this we love and inspirstional poems in Nigerian pidgin language. Do well to send it to the person wey dey give you joy unlimited.

Pidgin English Romantic Love Poem

It is always good to be right there for the one you love. Standing together and overcoming all challenges together would always make that souldmate of your to be so proud of you anytime, any day. Inspire love with this sweet Nigeria love poem. This na better matter for the person wey dey give you joy. If you care for that your sweetest heart, this naija way romantic poem na wey thing you personal person need.

I Want To Be There For You

I want to be there
Just for you
I want to be there
Right by your side
I just want to be there
To be close to you
I want to be with you
Just like your shadow.

Today and always
I just want to be there for you
To hold you close to my heart
And smile into your face
To make you feel the comfort
That would reassure you of my love.

I want to be there for you
Like every rising of the sun
I want to be your one and only
The very true love you can cherish
To keep, to admire and to adore
I just want to be there for you
If that is all I have to do for love
I just want to be your true love.

Nsikak Andrew

Poetic Pidgin Nigerian Inspirational Poem

Naija poetic pidgin na dey the main thing. Language has power and you can communicate with any language without barrier. This Nigerian poetic pidgin inspirational poem go inspire you if you inspirational poetic poems. This message na real poem wey go inspire you far beyond your imagination. If you value words of motivation, you will enjoy this proverb kind of poem.

Na Who Know Tomorrow

Person wey first marry
Na him marry ugly woman.

Person wey buy car first
Na him buy old model.

For this life make you no rush
Abeg take am sufri-sufri
Turn by turn na so life be.

If you want better thing
Na to work for it
If you no work, you no go chop.

No dey look person face
Come think say your help dey their hand
Na you get the power to make up thing.

Nobody sabi tomorrow that na better talk
If you start your tomorrow for today time
That na sure matter say tomorrow go good.
Take life turn by turn, na so you go get there.

Nsikak Andrew

Nigeria Motivational Poem In Pidgin English

Enjoy this our Nigerian pidgin language poem wey relate to motivation and inspiration. This na better pidgin poem wey dey warn person about life. If you sincerely want to make a better living, this na clarion call for you not to be oversabi. It is good you cool down sometimes if actually you want to make a meaning out of your life. There is no need to do overside because this way of life dey spoil things for person.

Oversabi

Wetin you be
Wey you no fit cool down
About, about you dey bisi body
I be this, I be that.

Wetin you be
Wey all you sabi na to razz around
Blowing your trumpet like say
Na you owe Wall Street.

Wetin you be
Wey all you sabi
Na to blow cut and joint grammar
Come dey pose like Guinea fowl.

Abeg wetin you be
Wey small change dey swell your head
Tell me, wetin you be sef
Wey you want take oversabi kill your sef o!

Nsikak Andrew

Political Poem for Naija English Language

Every man na political animal. When things goes wrong in a nation, who we go blame? If you ask me, na who I go ask. Sometimes, it pains when we see the abuse of our legal currency from the people wey suppose protect am. Anyhow sha, things go turn for better. Abeg make you share am with the people wey love you better pass the way wey you love yourself if that one dey possible.

Muri - The Naira Abuse

A note of honour
In honour of the assassinated General
A note of honour in exchange of liberty
A note, whose legality has been abused.

Men in black and black
Men in black and green
Even men in green and green
Now men in brown and black
And those in agbada are partakers
In our Muri-abuse.

Every drop, every block…
Muri’s hand must grease the palms
Failures are stories the undertaker have heard.

Muri-abdusers,
Just when shall you say good-bye?

Nsikak Andrew

Naija Romantic Pidgin Love Poem

Love na the main thing. If you are in love you would always find it rewarding to share the sweet romantic experience. Naija na the country of happy people and here our love make sense die. Be inspired with our Naija way of expressing love with this Pidgin love poem in English language. If you still dey with your better sweet heart, make you send am this tears for love romantic Naija pidgin poem.

I Love You, I Love You

I love you, I love you
No be for mouth
Man wey no get money
Wetin woman want take am do
Abeg na who send poor man.

The guy is good, the Bobo correct
Na him pocket make am o
Soup wey sweet, na money kill am
Woman wey fine, na change make am-o!

I love you, I love you,
No be for mouth
Something dey inside-o!

Nsikak Andrew

Romantic Nigeria Love Poem for Her

Who say love na to blow big big grammar. If you think say love na grammar, then make you remember say shoe get size. E better make you cut your material according to your size. This Pidgin love poem go make sense for your one and only. We love you and that is why we want you to come smile with us with this romantic Nigerian love poem.

Love No Be Grammar

Money no fit buy love
That na Oyibo palava
Ask African woman
Then you go know say
Love no be grammar.

Ask Omoge how do you do
If your pocket dry
Like Sahara desert
And if she buy your story
Then love na grammar.

Quote all the Shakespeare!
Read all the Romeo and Juliet for her
Blow all the Oyibo grammatical wey you sabi
If money no dey for hand
Back no go touch ground
Grammar no be love.

Give Oyibo women flower
She go cherish you pass Mango
Try African women
You go hear "na flower I go chop"
Wetin African woman sabi?
If you say na money, me I no dey o.

Nsikak Andrew

Post a Comment

Post a Comment (0)

Previous Post Next Post
Advertisement
Advertisement